Dataset Viewer
Auto-converted to Parquet Duplicate
audio
audio
text
string
how you dey now
hope sey you sleep well
ah my sister i sleep well o
una get light for una area last night
we no get o
ah wetin happen now
toh na nepa o
aha dese people i hear sey de dey share di light
my sister di tin tire me o
de just dey share am but de go dey bring big bill
in fact dat bill na anoder tin again
na so my sister
how much de dey how much how much de dey give una for una bill
ah my sister na seven thousand o
seven thousand for di light wey we no dey see
ah dese people eh de no go kill person o
toh how you dey manage now
my sister i dey manage am
eyah god go help us
e get one soup like dat wey mama maro bin teach me
di soup make sense
i hear sey na ibo soup
i know sey you go like am
teach me too now
shebi you know banga soup
i know banga soup
ehn na di soup
so its like i go come me and you go go do am
di soup go make sense
you go like am well well
abi meh i give you
you know how de take dey cook di soup
ah my sister my junior sister bin teach me how de take dey cook am o
you fit tell me small
eh e say you go parboil di banga
after you parboil am you go come pound am
when you pound am you filter am
den you put eh your ingredient inside
na so my teacher my sister take teach me
na starch or na eba
i dey like starch well well
starch hm na starch i dey like
ehn na dat one i dey like pass
dis morning wetin you eat before you come here
ah my sister o mtschew toh i eat eba o
hehe why you no drink tea
hm my sister i no dey too like tea
na swallow i like pass
okay wetin you eat before you sleep for di night
ah well my sister i just take small rice
hope sey di rice sweet sha
so any any news
you hear any news for area
concerning dis our nepa issue i bin hear sey de say de wan come cut light tomorrow
my sister na so i hear am o
de say de wan come cut light tomorrow
make dese people no come o because we don tire for dem
me masef i no even get money to pay
hey dis one na wahala o
dis one wey everywhere dry no money
i just pray make dem no come
make dem no come
because if de come dat means na all di whole area dem go cut deir light o
because people no no money
and we no dey see light
hm meh nepa no try us o
i no sure sey dem go even come sef
madam i wan make me and you go market next market day
gwagwalada market abi kwali
which day be kwali market
ah we go try go o
wetin you wan go buy now
i wan go buy shop tins
mtschew e get some kind tins wey i need for my shop
i wan make me and you go
because you no go see provision dere o
eh na true o
i fit see shampoo and attach ba
my sister you no go see o
na food product dey dere
if we go toh we would just buy tins wey we go take cook some kind soup
when i wan go i go come call you
i go house dey wait you
me too mey i go hustle for money so dat if we go i go buy enough tins
i go call you
dat your number wey give me last eh last week shebi na di number you still dey use
na im i still dey use
x sometime i dey try di number
di number no dey go o
ah dis network again
i go flash you with my number before we leave here
i dey expect am
which church you dey go now
my sister na cac
you don comot for pathfinders
hm mtschew i don comot jor
dey go cac now
eyah how di church now
ah we thank god
hope sey de dey preach well
End of preview. Expand in Data Studio
README.md exists but content is empty.
Downloads last month
17